Song of Solomon 2pcm

1Na mi bi di Rose flower from Sharon, di lily flower for di valley.

2Just as lily flower dey among shuku-shuku, na so my darlin bi among oda yong wimen.

3Just as apple tree dey among oda trees for forest, na so my love bi among di yong men. I dey like sidan for where e dey and en fruit dey sweet mi to chop.

4E take mi go di party kon show mi as e love mi rish.

5E give mi kake, so dat I go get pawa kon add apples join am, bikos en love won make mi faint.

6E dey rub my head with en left hand kon dey massage mi with en rite hand.

7Jerusalem wimen! Make una promise mi with animals, like deer and gazelle sey, una nor go disturb awa love.

8Make una listin! My love dey kom. Si! E dey pass di mountins and di hills dey kom meet mi.

9My love bi like gazelle or yong deer. Look! E stand for back of awa wall, where e for dey look di room thru di window.

10My love tell mi sey, “Get up, my darlin! My fine wife, make yu kom follow mi go!

11Si! Kold sizin don pass and rain nor dey fall again.

12Di flowers don dey grow and di time wen birds dey sing, don kom and naw, wi dey hear dove dey sing for awa land.

13Fig tree don dey bring fig fruit kom out and di breeze dey scent with fresh vines. So get up, make yu follow mi, my darlin and sweet wife; kom follow mi make wi dey go!”

14Yu bi like dove wey hide inside rock, so make yu allow mi si yor fine face kon hear yor sweet vois.

15Make una katch all di fox for us; especially di small-small ones, before dem go distroy awa vineyard.

16My love na my own and I bi en own too; e dey feed en animals for where lilys dey.

17My love, before di morning breeze go blow and darkness go disappear, make yu kom back kom meet mi like gazelle or yong deer wey dey on-top mountin.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Song of Solomon 2.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.