Song of Solomon 1pcm

1Dis na Solomon love song.

2Yes! Make yu kiss mi well-well, bikos to sleep with yu sweet pass wine.

3Si as yor perfume dey scent well-well and yor name bi like di perfume wey fine pass. No wonder wimen love yu well-well!

4Draw mi follow yu! Make wi kwik komot here! Make di king take mi go en room. Awa king, wi dey happy well-well, bikos of yu and wi like yor love pass wine. Yes, di yong wimen dey honor yu and dat na di rite tin to do.

5Jerusalem wimen, I bi black and fine woman; I black like Kedar and Solomon tents.

6So make una nor dey look mi anyhow bikos sun don make my skin black. My brodas dey vex for mi, so dem kon force mi dey work for farm and bikos of dat, I nor fit kare for my body.

7My love, make yu tell mi! Na where yu won go feed yor animals today? Where yor sheep dem go for rest dis aftanoon? Make yu tell mi, if not I go dey waka up-and-down like ashawo for where yor friends and dia animals dey!

8My woman! Di one wey fine pass among wimen! If yu dey find mi, make yu follow my animals footstep rish where I dey kon kare for yor small goats near di shepad tent.

9My love, yu bi like woman horse for where Fero man horse dem dey.

10Yor face dey shine well-well, bikos of di oil wey dem take rub am and di difren shains wey yu wear, don make yor neck fine too.

11So, wi go make gold ear-ring and silva beads for yu.

12As di king sidan for en tabol where e for dey do party, my perfume smell kon make am dey happy.

13As my love put en head on-top my breast thru-out di nite, en whole body kon dey smell like myrrh.

14My love bi like Henna flower wey dey shine well-well for En-Gedi Field.

15Si as my darlin fine well-well, make yu si as yu fine rish! Yor eyes bi like dove own!

16Yes! Yu too fine my love and I dey happy to always dey with yu. Na di grass go bi awa bed

17and na cedar wi go take design awa house kon build di roof with Cypress tree.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Song of Solomon 1.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.