Song of Solomon 3pcm

1As I sleep for my bed thru-out di nite, I find di one I love with my heart and soul, but I nor si am.

2So I tell mysef, “I go get up go di town, enter di street kon follow korna-korna go find di pesin wey I love.” So I find evriwhere, but I nor still si am.

3So wen I si di men wey dey guide for nite, I kon ask dem, “Una si my love?”

4As I waka pass dem small, I kon si di pesin wey I love. I hold am tight and I nor wont make e go, so I take am go my mama house; to di bedroom where e for get my belle.

5So Jerusalem wimen, make una promise mi with gazelle and deer sey una nor go disturb awa love.

6Who dey waka kom from di desert like smoke or like incense and myrrh? Na fine incense wey dem dey sell?

7Si! Na Solomon dem karry for en throne dey kom and na sixty fine sojas for Israel dey guide am.

8All of dem sabi use swod well and dem train dem well to fight war. Each of dem swod dey near dia waist and dem dey guide against anybody wey won attack dem for nite.

9King Solomon use Lebanon wood take make one chair for ensef.

10Dem make di korna with silva kon design di back with gold. Na purpol klot dem take wrap am and na Jerusalem wimen dekorate am with leda.

11So Jerusalem wimen, make una kom si King Solomon dey kom. E wear di crown wey en mama take crown am for di day wen e marry and na dat day, sweet pass for en life.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Song of Solomon 3.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.