Bible

Designed

For Churches, Made for Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 99

:
Nigerian - pcm
1 Na God bi king! Make di nashons shake with fear! E sidan for en throne where di angels wey get feadas dey and make di eart shake.
2 God dey great for Zion and naim bi Oga ova all di nashons.
3 So, make wi praiz God great and wonderful name, bikos E dey holy!
4 Di king dey strong; E love to judge well. God dey make sure sey dem judge evry kase well. Na Yu make betta judgement and raitiousness dey for Israel land.
5 So make una praiz di Oga awa God! Make una bow woship am, bikos E dey holy!
6 Moses and Aaron dey among en priests; Samuel na one among di pipol wey pray to am. Dem pray to God and E ansa dem.
7 E tok to dem from di kloud wey kom as pila and dem obey en kommand and laws wey E give dem.
8 My Oga God! Yu really ansa dem. Even doh Yu bi God wey dey ponish pipol for di bad tins wey dem do, dem still si sey Yu bi God wey dey forgive.
9 So make wi praiz di Oga awa God! Make wi woship am for en holy hill, bikos di Oga awa God, dey holy!