1Make una sing new song for God, bikos E don do wonderful tins! E dey diliver pipol with en rite and strong hand.
2God show en pawa to diliver and en goodness to evribody!
3E don remember en promise to love and kare for Israel pipol and di whole eart don si God viktory.
4So make all di eart shaut to God; make all of dem bigin praiz and sing for joy!
5Make dem sing dia praiz give God with harp, sweet-sweet songs,
6trumpets and di sound from ram horn. Make una sing with praiz, before di King wey bi awa God.
7Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God! Make di eart and evry living tin join dem too.
8Make di rivers klap dia hand as dem dey praiz God. Make di hills sing dia song for joy
9before awa Oga God, bikos E dey kom judge di whole world. E go judge di whole world well kon judge evribody, with raitiousness.