Bible

Focus

On Your Ministry and Not Your Media

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 98

:
Nigerian - pcm
1 Make una sing new song for God, bikos E don do wonderful tins! E dey diliver pipol with en rite and strong hand.
2 God show en pawa to diliver and en goodness to evribody!
3 E don remember en promise to love and kare for Israel pipol and di whole eart don si God viktory.
4 So make all di eart shaut to God; make all of dem bigin praiz and sing for joy!
5 Make dem sing dia praiz give God with harp, sweet-sweet songs,
6 trumpets and di sound from ram horn. Make una sing with praiz, before di King wey bi awa God.
7 Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God! Make di eart and evry living tin join dem too.
8 Make di rivers klap dia hand as dem dey praiz God. Make di hills sing dia song for joy
9 before awa Oga God, bikos E dey kom judge di whole world. E go judge di whole world well kon judge evribody, with raitiousness.