Psalms 97pcm

1God na king! Make di eart happy! Make river and sea happy too.

2Dark kloud dey round am. Na to do rite and judge well, bi di foundashon for en throne.

3Fire dey round God for front and E burn all en enemies for evry side.

4En tonda lite dey shine round di eart, so wen di eart si am, e kon dey shake.

5Di mountins dey melt like butter wen dem si God wey get di whole eart.

6Di heavens dey tok about en raitiousness; evribody dey si en glory.

7But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju; doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin, bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.

8Jerusalem pipol and all di towns for Judah don hear about am and dem dey happy, bikos of how God dey judge pipol!

9Yu, God get pawa pass evritin for dis world; so dem go praiz Yu pass any oda god.

10Una wey love God, make una hate bad tins! God dey protet pipol wey dey fear am kon save dem from wiked pipol pawa.

11Pipol wey dey fear God, lite dey shine for dia body and doz wey get pure heart, dey always happy.

12So make evribody wey dey fear God, happy kon praiz en holy name!

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 97.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.