1Make una sing new song for God! Make di whole world sing to am!
2Make una sing and praiz God name. Evriday, make una tok about di good news sey, “E dey save en pipol.”
3Make una rite di wonderful tins wey E do among di nashons. Make una tell evribody about di good-good tins wey E do.
4God dey great! Make all praiz bi en own! E big pass all di oda gods.
5Oda nashons god, na just juju dem bi, but na awa God make di heavens!
6Honor and majesty dey round am; strent and beauti dey en temple.
7Make all di nashons for di world know God well; make dem know sey God strong well-well and E get glory.
8Make una give God di glory wey bi en own! Make una bring una ofrin as una dey enter en temple.
9Make una woship God with all en glory and wonders. Make all di eart shake fall for en front.
10Make una tell di nashons sey, “Na God dey reign!” Di world stand gidigba and dem nor go fit shake am. God go judge evribody akordin to wetin dem do.
11Make di heavens and di eart dey happy! Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God!
12Make di field and di plants, shaut for joy! Make di trees for forest dey make sound with praiz
13before God, bikos E dey kom! Yes, E dey kom judge di eart. E go judge di world well-well and E go judge evribody akordin to wetin dem do.