Psalms 95pcm

1Kom make wi sing praiz God! Make wi shaut praiz di Rock wey dey save us.

2As wi dey kom meet am, make wi sing songs take tank am. Make wi sing psalms take praiz am.

3Di Oga na great God! Na great King wey pass evry oda god.

4Under di eart dey en hand and na-im get di mountins too.

5Na-im get di sea, bikos na-im make am and na en hand E take make di dry land too.

6Kom! Make wi go woship and bow to am. Make wi knee down before God wey make us,

7bikos na-im bi God. Wi bi en pipol and E dey wosh ova us, bikos na wi E dey kare for.

8God sey, “Make una nor sturbon as Israel pipol do wen dem dey Meribah and Massah wey dey di wildaness.

9Bikos for der, even doh dia grand-grand papa dem si evritin wey I do, dem still test and try my patient.

10So, I vex for dem for forty years kon sey, ‘Dis pipol heart don turn from mi and dem nor gri do wetin I tell dem.’

11So I kon swear as I dey vex sey: ‘Dem nor go ever enter my place where rest dey.’ ”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 95.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.