Bible

Elevate

Your Sunday Morning Worship Service

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 95

:
Nigerian - pcm
1 Kom make wi sing praiz God! Make wi shaut praiz di Rock wey dey save us.
2 As wi dey kom meet am, make wi sing songs take tank am. Make wi sing psalms take praiz am.
3 Di Oga na great God! Na great King wey pass evry oda god.
4 Under di eart dey en hand and na-im get di mountins too.
5 Na-im get di sea, bikos na-im make am and na en hand E take make di dry land too.
6 Kom! Make wi go woship and bow to am. Make wi knee down before God wey make us,
7 bikos na-im bi God. Wi bi en pipol and E dey wosh ova us, bikos na wi E dey kare for.
8 God sey, “Make una nor sturbon as Israel pipol do wen dem dey Meribah and Massah wey dey di wildaness.
9 Bikos for der, even doh dia grand-grand papa dem si evritin wey I do, dem still test and try my patient.
10 So, I vex for dem for forty years kon sey, ‘Dis pipol heart don turn from mi and dem nor gri do wetin I tell dem.’
11 So I kon swear as I dey vex sey: ‘Dem nor go ever enter my place where rest dey.’