Psalms 100pcm

1Make evritin wey dey dis eart, shaut with joy to God!

2Make una happy as una dey woship God. Make una sing with joy as una dey kom meet am.

3Make una know sey na di Oga God bi God! Na-im make us and wi bi en pipol. Wi bi en pipol, di sheep wey dey en field.

4So make una sing tanksgivin song as una dey enter en present! Make una enter en temple with tanksgivin. Make una tank and praiz en name.

5Bikos God dey good, en love wey nor dey fail dey forever and E dey good from one generashon go rish anoda.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 100.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.