Bible

Elevate

Your Sunday Morning Worship Service

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 100

:
Nigerian - pcm
1 Make evritin wey dey dis eart, shaut with joy to God!
2 Make una happy as una dey woship God. Make una sing with joy as una dey kom meet am.
3 Make una know sey na di Oga God bi God! Na-im make us and wi bi en pipol. Wi bi en pipol, di sheep wey dey en field.
4 So make una sing tanksgivin song as una dey enter en present! Make una enter en temple with tanksgivin. Make una tank and praiz en name.
5 Bikos God dey good, en love wey nor dey fail dey forever and E dey good from one generashon go rish anoda.