1My God, I go sing about yor love and how Yu dey judge! I go praiz Yu with difren song.
2Make Yu help mi to do di rite tin, so dat I go dey honest and dey do good as I dey rule my kingdom.
3I nor go even tink to do bad tin and I nor go join pipol do bad tins.
4I nor go follow bad pesin make friend; I nor go tink of evil at-all.
5I go distroy anybody wey dey plan bad for en neighbour and I nor go sorry for who dey deceive pipol or doz wey get pride.
6I go favor di good pipol wey dey di land and dem go kom stay with mi. Na only doz wey nobody dey tok bad about, go serve mi.
7I nor go allow pipol wey dey deceive odas, serve for my house and doz wey dey lie, nor go stay for my present.
8Evriday, I go distroy wiked pipol for di land and doz wey dey do evil, I go drive dem komot from God town.