Psalms 102
1 My God, make Yu hear my prayer! Make Yu listin to my kry for help!
2 Make Yu nor turn from mi wen I dey trobol. Listin and kwik ansa mi wen I koll Yu.
3 Bikos my days dey disappear like smoke and my bones dey hot like wetin fire dey burn.
4 My heart dey weak; my body dey dry go like grass and I nor fit chop anytin.
5 Bikos of di pains wey I dey feel, my bones don almost kom out from my skin.
6 I bi like owl for desert; like small owl for inside-inside wildaness.
7 I nor fit sleep, I bi like bird wey only en dey on-top roof.
8 My enemies dey wahala mi evriday. Dem dey laf and curse mi.
9 Na ashes I dey chop as food and my tear dey rush enter my drink,
10 bikos of di way Yu dey vex for mi. Yu don pick and trow mi go down.
11 My life dey pass kwik-kwik like shadow for evening and I dey die go like grass.
12 But Yu, my Oga God go sidan for yor throne forever and evry generashon go know how Yu dey great.
13 Yu go raiz-up kon sorry for Jerusalem, bikos dis na di time wen Yu go favor am. Yes! Dis na di rite time to help am.
14 Bikos yor pipol love all di stones wey dey di town wall and di dust wey dey di street.
15 Just as di nashons go fear wen dem si God, na so too kings go fall wen dem si en glory,
16 bikos E go ribuild Jerusalem kon appear inside en glory.
17 Pipol wey dey sofa, E go listin to dia prayers. E nor go rijet dem wen dem dey beg am.
18 So, make una rite dis tin down for una shidren-shidren, so dat wen dem born dem, dem go praiz God.
19 Make una tell dem sey God dey look down from en temple for heaven. E dey look di eart from heaven
20 to hear di prisonas kry for help and to release doz wey dem won kill.
21 So, make evribody for Zion celebrate God greatness and make dem praiz am for Jerusalem
22 wen ever dem and di difren kingdoms gada to woship God.
23 E don take my strent, even doh I still dey alive! E don make my days for di world, short.
24 I sey, “My Oga God, make Yu nor let mi die naw wen I still dey yong, bikos Yu dey from one generashon go rish anoda.
25 Na wen di world just start, Yu build di foundashon for di eart kon make di heavens with yor hand.
26 Even wen dem skata, Yu go dey forever. Dem go tear like garment and Yu go remove and distroy dem like one old klot.
27 But Yu go always bi who Yu bi; Yu go dey forever.
28 Yor savant shidren-shidren go always dey save. Dia shidren-shidren go always dey save for yor present.”