Psalms 102pcm

1My God, make Yu hear my prayer! Make Yu listin to my kry for help!

2Make Yu nor turn from mi wen I dey trobol. Listin and kwik ansa mi wen I koll Yu.

3Bikos my days dey disappear like smoke and my bones dey hot like wetin fire dey burn.

4My heart dey weak; my body dey dry go like grass and I nor fit chop anytin.

5Bikos of di pains wey I dey feel, my bones don almost kom out from my skin.

6I bi like owl for desert; like small owl for inside-inside wildaness.

7I nor fit sleep, I bi like bird wey only en dey on-top roof.

8My enemies dey wahala mi evriday. Dem dey laf and curse mi.

9Na ashes I dey chop as food and my tear dey rush enter my drink,

10bikos of di way Yu dey vex for mi. Yu don pick and trow mi go down.

11My life dey pass kwik-kwik like shadow for evening and I dey die go like grass.

12But Yu, my Oga God go sidan for yor throne forever and evry generashon go know how Yu dey great.

13Yu go raiz-up kon sorry for Jerusalem, bikos dis na di time wen Yu go favor am. Yes! Dis na di rite time to help am.

14Bikos yor pipol love all di stones wey dey di town wall and di dust wey dey di street.

15Just as di nashons go fear wen dem si God, na so too kings go fall wen dem si en glory,

16bikos E go ribuild Jerusalem kon appear inside en glory.

17Pipol wey dey sofa, E go listin to dia prayers. E nor go rijet dem wen dem dey beg am.

18So, make una rite dis tin down for una shidren-shidren, so dat wen dem born dem, dem go praiz God.

19Make una tell dem sey God dey look down from en temple for heaven. E dey look di eart from heaven

20to hear di prisonas kry for help and to release doz wey dem won kill.

21So, make evribody for Zion celebrate God greatness and make dem praiz am for Jerusalem

22wen ever dem and di difren kingdoms gada to woship God.

23E don take my strent, even doh I still dey alive! E don make my days for di world, short.

24I sey, “My Oga God, make Yu nor let mi die naw wen I still dey yong, bikos Yu dey from one generashon go rish anoda.

25Na wen di world just start, Yu build di foundashon for di eart kon make di heavens with yor hand.

26Even wen dem skata, Yu go dey forever. Dem go tear like garment and Yu go remove and distroy dem like one old klot.

27But Yu go always bi who Yu bi; Yu go dey forever.

28Yor savant shidren-shidren go always dey save. Dia shidren-shidren go always dey save for yor present.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 102.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.