1My soul, make Yu praiz God! Make evritin wey dey inside mi, praiz en holy name!
2My soul, make Yu praiz God! Make Yu nor forget all di good tins wey E don do!
3Na-im dey forgive pipol dia sins and dey heal difren-difren diziz.
4E save awa life from di pit kon crown us with mesi and en love wey nor dey fail.
5E satisfy awa life with good tins and even as wi still dey yong, awa life strong like eagle own.
6God dey do wetin dey good and dey judge well for doz wey dem dey opress.
7God show en good works to Moses and en faithfulnes to Israel pipol.
8God dey sorry and show mesi to pipol well-well; E nor dey kwik vex and en love for us nor dey fail.
9E nor dey always akuiz pipol or vex tey for dem.
10E nor dey use as awa sin big rish, take ponish us.
11As di sky high from di eart, na so too en love for pipol wey dey fear and serve am, big rish.
12Just as east far from west, na so too E make awa sins far from us.
13Just as papa dey love and pity for en shidren, na so too, God dey good and dey sorry for doz wey dey fear am.
14Bikos E know how E take kreate us kon remember sey na dust wi bi.
15Awa days for dis world bi like grass; just as flower dey shine kon die, na so too wi dey shine, but small time wi go die.
16Wons heavy breeze blow, di flower dey die komot like sey e nor dey der before.
17But God love go dey forever for pipol wey dey fear am. En salvashon go dey for dia shidren-shidren;
18doz wey dey faithful to en kovenant and dey obey en kommand!
19God don make heaven en throne and na from der E dey rule evritin.
20So angels, make una praiz God: Di strong angels wey dey obey am and listin to all en kommand.
21Yes! Make una praiz God, all di strong angels wey dey serve and do wetin E wont!
22Evritin wey God kreate, make una praiz God for evriwhere for en kingdom. Make my soul praiz God!