1God stand for where en pipol gada put and E from der dey judge di oda gods
2sey, “Na how long una go dey judge like dis kon dey favor wiked pipol?
3Poor pipol and doz wey nor get papa, make una judge dia kase well! Make una free poor pipol and doz wey dem dey opress.
4Poor pipol and doz wey nor get help, make una save dem from wiked pipol!
5But doz wey dey opress oda pipol, nor know anytin at-all. Dem bi fools! Dem dey waka anyhow for darkness, while all di foundashon for di eart dey skata.
6I bin sey, ‘Una bi gods; bikos una bi di Most High God shidren.’
7But naw, una go die like ordinary human being kon fall like evry oda leader.”
8So my God, make Yu raiz-up kon judge di world, bikos na Yu get all di nashons.