Bible

Simplify

Your Church Tech & Streamline Your Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 82

:
Nigerian - pcm
1 God stand for where en pipol gada put and E from der dey judge di oda gods
2 sey, “Na how long una go dey judge like dis kon dey favor wiked pipol?
3 Poor pipol and doz wey nor get papa, make una judge dia kase well! Make una free poor pipol and doz wey dem dey opress.
4 Poor pipol and doz wey nor get help, make una save dem from wiked pipol!
5 But doz wey dey opress oda pipol, nor know anytin at-all. Dem bi fools! Dem dey waka anyhow for darkness, while all di foundashon for di eart dey skata.
6 I bin sey, ‘Una bi gods; bikos una bi di Most High God shidren.’
7 But naw, una go die like ordinary human being kon fall like evry oda leader.”
8 So my God, make Yu raiz-up kon judge di world, bikos na Yu get all di nashons.