Bible

Say Goodbye

To Clunky Software & Sunday Tech Stress!

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 81

:
Nigerian - pcm
1 Make wi sing praiz God wey bi awa strent. Make wi sing praiz Jakob God.
2 Make una sing and play sheke-sheke. Make una use jita and harp play sweet music.
3 Make una blow ram horn wons new moon or full moon festival start!
4 Bikos dis na wetin dem rite for Israel law and na wetin Jakob God kommand.
5 E make dis law for Israel pipol wen E attack Egypt land just to free us. Den I hear one vois wey I nor know dey sey,
6 “Si, I don take di load komot from una shoulder; I don free una from di heavy work wey una dey do.
7 Una kry to mi for help wen una dey trobol and I save una; I ansa with strong tonda kon test una faith wen wota nor dey to drink for Meribah.
8 My pipol make una listin to mi as I dey warn una! Israel pipol, make una obey mi!
9 Una must nor serve anoda god; una must nor bow before any oda god.
10 Bikos na mi wey bi una Oga God, save una from Egypt land. Make una open una mout wide and I go pak good tins full am.
11 But my pipol nor gri listin. Israel pipol nor wont make I dey with dem.
12 So I let dem do di tins wey dey hongry dem to do kon live dia life di way dem wont am.
13 How I wish my pipol go gri listin to mi! How I wish sey Israel pipol go follow mi kon do as I tell dem!
14 Den I for fit kwik distroy dia enemies! My hand for kwik tosh doz wey dey worry dem!
15 Make pipol wey hate God, fear as dem si am; make disgrace follow dem forever.
16 But I go give Israel pipol betta food chop; I go make una beleful with betta honey wey dey flow kom out from di rock.”