1Di Shepad for Israel, make Yu listin to us. Yu wey dey kare for Josef shidren-shidren, just as shepad dey kare for en sheep. My God wey high pass di angels, make Yu show yor glory wey dey shine
2to Efraim, Benjamin and Manasseh pipol. Make Yu show yor mighty pawa, den kom save us!
3My God, make Yu bring us back to yorsef again. Make yor face shine upon us again and na only den wi go get rest of mind.
4My Oga wey bi God for Heaven Sojas, na how long Yu go dey vex for awa prayers?
5Yu don make us dey chop sorrow like food kon drink tears wey full bucket.
6Yu don give oda pipol rizin to dey laf us and naw, awa enemies don take us dey do yeye.
7My Oga wey bi God for Heaven Sojas, make Yu bring us back to yorsef again. Make yor face shine upon us again and na only den wi go get rest of mind.
8Yu take us from Egypt like grape fruit, den Yu porshu di wiked nashons kon give us dia land.
9Yu klear di groun for us and wi stay der kon many for di land.
10Awa shadow dey kover di mountins; awa branches dey kover di mighty cedars.
11Before-before, wi spread go west for Mediterranean Sea and Eufrates River.
12But naw, wetin make Yu break awa walls so dat evribody wey dey pass go fit tif awa fruit?
13Even wild animals from bush dey kom chop dem too.
14Awa God, di Warrior wey nobody dey si, wi dey beg make Yu kom back. Make Yu from heaven look kon si di wahala wey wi dey face. Make Yu kare for dis grape tree
15wey Yu plant by yorsef; bikos na Yu raiz dis pikin up by yorsef.
16Make awa enemies nor chop and burn us finish. Make dem die, bikos Yu nor dey happy with dem.
17Make Yu support di ones wey Yu choose; di ones wey Yu raiz for yorsef!
18Den wi nor go turn from Yu. Make Yu bring us back and wi go pray to Yu!
19Awa God, di warrior wey nobody dey si, make Yu give us life again! Make Yu just smile for us and wi go dey save!