Psalms 83pcm

1My God, make Yu nor kwayet just like dat! Make Yu nor rijet us! Nor just do like sey e nor koncern Yu!

2Yu nor si di nois wey yor enemies dey make? Yu nor dey si sey yor sturbon enemies dey make mout anyhow?

3Dem dey plan against yor pipol and dem won wound di ones wey Yu love.

4Dem dey sey, “Make una kom make wi kill evribody for Israel finish and nobody go remember dem again.”

5All of dem gada togeda and dem dey plan against Yu.

6Dem wey gada so na: Edom and Ishmael pipol, Moab and Hagrit pipol;

7Gebal, Ammon and Amalek pipol with doz from Filistia and Tyre.

8Assyria pipol don join dem too with Lot shidren-shidren.

9So, make Yu do dem wetin Yu do Midian pipol and just as Yu do Sisera and Jabin for Kishon River, na so too Yu go do dem.

10Dem die for Endor and dia body kon make di grass grow well.

11Make di mighty ones among dem die like Oreb and Zeeb. Make all di prince die like Zebah and Zalmunna

12wey bin sey, “Make wi take dis land wey bi God own!”

13My God, make Yu skata dem like leaf and san-san wey breeze dey blow!

14As fire dey burn forest and smoke dey make mountin burn,

15na so too Yu go take porshu dem with yor strong tonda kon make dem fear.

16My God, make Yu disgrace dem finish until dem bigin praiz yor name.

17Make shame and fear follow dem forever and make dem die with disgrace.

18Den dem go know sey na only Yu bi God, di Pesin wey get pawa pass for di whole world.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 83.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.