1I shaut and kry to my God; yes I shaut and E hear mi!
2Wen I dey trobol, I look for God. Thru-out di nite, I pray and lift my hand go heaven, but nor-tin fit konfort my soul.
3Wen ever I tink of God, na kry I always dey kry make E kom help mi.
4Yu nor dey let mi sleep and I too dey weak to pray!
5I bin dey tink of di good days before-before,
6wen betta song with joy full my nite. But naw, I dey look my life kon dey tink and si how e dey difren.
7So God don rijet mi forever? E nor go ever show mi en love again?
8En love wey nor dey fail don go forever? E promise don fail finish?
9God don forget to dey sorry for pesin? E don klose di door to pipol wey dey kom meet am for help?
10So I kon sey, “Na mi kause am! Na mi let God turn en hand against mi”
11But my Oga God, I remember evritin wey Yu don do. I remember all di wonderful tins wey Yu do before.
12Dem always dey my mind and I nor fit stop to dey tink about di mighty tins wey Yu do.
13My God, yor ways dey holy. E get any god wey get pawa like Yu?
14Na Yu bi God wey dey do great wonders! Yu dey show yor great pawa among di nashons.
15With yor hand, Yu save yor pipol wey bi Jakob and Josef shidren-shidren.
16My God, wen di Red Sea si Yu, di wota kon dey fear and di sea shake rish bottom.
17Rain fall kom down from di kloud and tonda nois full di sky, den yor arrow with lite kon dey shine.
18Dem hear yor vois like tonda from di strong wind, di lite make di world dey shine and di world kon dey shake with fear.
19Yu waka on-top di sea go diliver yor pipol kon strol pass di great river, but nobody fit si yor footstep bikos e nor show at-all.
20Den Yu use Moses and Aaron take lead and guide yor pipol like many sheep.