1God don show ensef to Judah pipol. En name dey great among Israel pipol.
2Na Jerusalem E dey stay and na Mount Zion bi en house.
3Na der E for break di enemies wiked arrow, dia guide, swod and all di tins wey dem take dey fight.
4En glory and majesty dey shine as E dey kom from di mountin where E for kill en enemies.
5Awa strong enemies don skata. Dem don sleep kon die go like dat, so nobody go fit fight us again.
6My Oga wey bi Jakob God, wen Yu breath, all yor enemies horse and shariot dey fall die.
7No wonder dem dey fear Yu well-well! Na who fit stand for yor front wen Yu dey vex?
8Na from heaven Yu dey judge yor enemies; di eart dey shake and dem dey kwayet for yor present.
9My God, Yu dey judge di pipol wey dey do wiked tins kon save doz wey dem dey opress for dis world.
10True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu. Yu really dey show as Yu dey vex rish.
11So, wen una vow give di Oga una God, make una keep una promise. Make evribody bring gift kon give di Holy One!
12E dey honbol prince and kings for dis eart, dey fear am.