Bible

Transform

Your Worship Experience with Great Ease

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 75

:
Nigerian - pcm
1 My God, wi tank Yu! Wi dey tank Yu bikos Yu dey near us and pipol for evriwhere dey tok about di wonderful tins wey Yu dey do.
2 God sey, “Wen di time wey I choose don rish, I go judge pipol.
3 Di eart go shake and evribody go fear, bikos na mi make di foundashon.
4 I don warn proud pipol sey, ‘Make dem stop to dey make mout!’ kon tell wiked pipol sey, ‘Make una nor dey happy sey una don win!
5 Make una nor tink sey una don win di fight or karry body up wen una dey tok.’
6 Viktory nor dey kom from east or west or from di wildaness,
7 bikos na God dey judge! E dey bring one pesin down and karry anoda pesin up.
8 One cup wey full with wine wey dem mix with spice, dey for God hand and E pour am for di world. True-true, all di wiked pipol for di world go drink from am till e finish.
9 But for mi, I go always dey tok about wetin Yu don do; I go sing and praiz Jakob God!
10 God sey, “I go distroy wiked pipol with dia pawa kon give viktory to pipol wey dey fear mi.”