Bible

Say Goodbye

To Clunky Software & Sunday Tech Stress!

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 72

:
Nigerian - pcm
1 My God, I beg Yu! Make Yu give di king di sense to dey judge well! Always allow di king pikin dey tok wetin dey korrect!
2 Den e go judge yor pipol and doz wey dem dey opress, well.
3 Di mountin go karry peace news kom meet yor pipol and di hills go tok about korrect judgement.
4 E go defend doz wey dem dey opress among di pipol, diliver poor pipol shidren and distroy doz wey dey opress pipol.
5 As long as di sun and moon dey di sky, pipol go always dey fear Yu from one generashon go rish anoda.
6 Wen di king dey rule, e go bi like wen rain fall on-top grass wey dem kut; e go bi like rain wey dey wota di groun.
7 All di pipol wey dey fear God go prosper as di king dey rule. So make goodness follow dem, as long as di moon dey shine for di sky.
8 Make di king rule from sea go rish sea and from Eufrates River go rish di end for di eart.
9 Desert go bow before am; en enemies go fall for groun for en front.
10 Tarshish kings for west and di oda kings go kon pay respet to am. Sheba kings for east and Seba go kon gi-am gifts.
11 All di kings go bow for am and all di nashons go serve am.
12 Di King go save poor pipol wen dem kry kom meet am kon help doz wey dem dey opress and doz wey nor get who go fight for dem.
13 E go pity for doz wey dey weak and poor kon save dem.
14 Bikos dia life dey important to am, e go save dem from pipol wey dey opress and kause wahala for dem.
15 Di king go live forever! Dem go dey gi-am gold from Sheba and di pipol go always dey pray and bless am evriday.
16 Food go many for di land and seeds go even dey grow well on-top mountins. Make trees bear betta fruit like di trees for Lebanon and make pipol for di land dey grow well like betta grass for di field.
17 Make di king rule forever; make en kingdom kontinue as long as di sun dey shine. Make blessing dey all di nashons bikos of am, so dat dem go praiz am.
18 Make una praiz di Oga wey bi Israel pipol God bikos of di wonderful tins wey E do and na only en fit do dem.
19 Make una praiz en name wey get glory forever! Make en glory dey di whole eart. Amen!
20 David wey bi Jesse pikin, na here en prayers for end.