Psalms 73pcm

1True-true, God dey good to Israel pipol and to doz wey dia heart dey pure.

2But for mi, my heart almost fail mi and my faith don nearly vanish,

3bikos I dey jealous proud pipol wen I si dem dey prosper, even doh dem wiked.

4E bi like sey dem dey enjoy life and dia body dey fresh and strong.

5Dem nor dey face trobol like oda pipol or si wahala like evry oda pesin.

6Dem wear pride like shain for neck kon wear yanga like belt for waist.

7Dia money dey make dem do wiked tins and na bad-bad tins dem dey always tink about.

8Evritin wey dem dey do and tok, na only about wiked tins and as dem dey proud, evritin wey dem wont, na to kill oda pipol.

9Dem dey boast like sey dem dey stay heaven and dey bihave like sey na dem get di world,

10so even God pipol dey bilive evritin wey dis wiked pipol dey tok.

11Dem dey ask, “How God won take know wetin wi dey do? Di Most High even know wetin dey happen so o-o?”

12Si dis wiked pipol dey enjoy life, bikos dia money dey plenty.

13So I konklude for my heart sey, “I just get klean heart for nor-tin! I just dey innocent and nor dey do bad tins for no rizin!

14Na only trobol I dey always get and evry morning dey kause pain for mi.”

15If to sey I don tok dis tins wey I dey tink, I for don betray doz wey dey obey Yu.

16So, even wen I try to undastand while wiked pipol dey prosper, e dey konfuse mi di more!

17Den I enter inside di temple go ask my God and E show mi en plans for wiked pipol.

18True-true, God put dem for di road wey dem go for fall kon make di groun for di hill wey go distroy dem, draw dem fall.

19Na wons God go take distroy and trowey dem down with fear.

20So my God, wen Yu raiz-up, Yu go laf dia yeye plan; wey bi like dream wey dey vanish wen day break.

21Yes, my heart dey bitter and I dey feel pain for inside my body.

22I bin dey do like fool wey sturbon. I know sey for yor present, I bin look like animal wey nor get sense.

23Yet, I still bilong to Yu and Yu hold my rite hand.

24Yu dey guide and advise mi as Yu dey lead mi enter where glory dey.

25Na who I get for heaven escept Yu? I wont Yu more dan anytin for dis eart.

26My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever.

27So doz wey nor dey fear am go die, bikos E dey distroy doz wey turn from am.

28But for mi, si as e good to dey near God! I don make di God wey get pawa my guide and I go tell evribody about di wonderful tins wey E don do.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 73.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.