Bible

Create

Inspiring Presentations Without Hassle

Try Risen Media.io Today!

Click Here

Psalms 73

:
Nigerian - pcm
1 True-true, God dey good to Israel pipol and to doz wey dia heart dey pure.
2 But for mi, my heart almost fail mi and my faith don nearly vanish,
3 bikos I dey jealous proud pipol wen I si dem dey prosper, even doh dem wiked.
4 E bi like sey dem dey enjoy life and dia body dey fresh and strong.
5 Dem nor dey face trobol like oda pipol or si wahala like evry oda pesin.
6 Dem wear pride like shain for neck kon wear yanga like belt for waist.
7 Dia money dey make dem do wiked tins and na bad-bad tins dem dey always tink about.
8 Evritin wey dem dey do and tok, na only about wiked tins and as dem dey proud, evritin wey dem wont, na to kill oda pipol.
9 Dem dey boast like sey dem dey stay heaven and dey bihave like sey na dem get di world,
10 so even God pipol dey bilive evritin wey dis wiked pipol dey tok.
11 Dem dey ask, “How God won take know wetin wi dey do? Di Most High even know wetin dey happen so o-o?”
12 Si dis wiked pipol dey enjoy life, bikos dia money dey plenty.
13 So I konklude for my heart sey, “I just get klean heart for nor-tin! I just dey innocent and nor dey do bad tins for no rizin!
14 Na only trobol I dey always get and evry morning dey kause pain for mi.”
15 If to sey I don tok dis tins wey I dey tink, I for don betray doz wey dey obey Yu.
16 So, even wen I try to undastand while wiked pipol dey prosper, e dey konfuse mi di more!
17 Den I enter inside di temple go ask my God and E show mi en plans for wiked pipol.
18 True-true, God put dem for di road wey dem go for fall kon make di groun for di hill wey go distroy dem, draw dem fall.
19 Na wons God go take distroy and trowey dem down with fear.
20 So my God, wen Yu raiz-up, Yu go laf dia yeye plan; wey bi like dream wey dey vanish wen day break.
21 Yes, my heart dey bitter and I dey feel pain for inside my body.
22 I bin dey do like fool wey sturbon. I know sey for yor present, I bin look like animal wey nor get sense.
23 Yet, I still bilong to Yu and Yu hold my rite hand.
24 Yu dey guide and advise mi as Yu dey lead mi enter where glory dey.
25 Na who I get for heaven escept Yu? I wont Yu more dan anytin for dis eart.
26 My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever.
27 So doz wey nor dey fear am go die, bikos E dey distroy doz wey turn from am.
28 But for mi, si as e good to dey near God! I don make di God wey get pawa my guide and I go tell evribody about di wonderful tins wey E don do.