Psalms 71pcm

1My God, I don run kom meet Yu make Yu protet mi; so nor let dem disgrace mi.

2Make Yu kom take and save mi, bikos Yu dey do wetin dey rite. Make Yu listin and diliver mi.

3Make Yu bi my Savior and di Rock where I go always hide put. Give kommand make dem save mi, bikos Yu bi my rock and di place where I dey hide put.

4My God, save mi from wiked pipol pawa and from doz wey dey opress mi,

5bikos na only Yu bi my hope and na from wen I bi small pikin, I don dey trust Yu kom rish naw.

6Yes! Yu don dey with mi since wen dem born mi and Yu dey kare for mi from my mama belle. No wonder I dey always praiz Yu!

7My life na ezample to many pipol, bikos na Yu bi my strent and proteshon.

8Dat na why I nor fit stop to praiz Yu and I go dey tok about yor glory evriday.

9Naw, for my old age, make Yu nor rijet mi. Make Yu nor leave mi wen I nor dey strong again.

10My enemies dey gossip mi. Dem dey plan how dem go take kill mi.

11Dem dey sey, “God don rijet am. So make wi go katch am, bikos nobody go help am again.”

12So, my God, make Yu nor leave mi, but make Yu hurry kom save mi.

13Make Yu disgrace and distroy pipol wey dey akuiz mi. Make disgrace and shame follow pipol wey won kill mi.

14But for mi, I go always dey wait for yor help and I go dey praiz Yu more and more.

15I go tell evribody about yor raitiousness and evriday, I go always dey tok about di pawa wey Yu take dey save, even doh I nor really fit esplain how e bi.

16My God wey get pawa, I go praiz Yu bikos of all di great tins wey Yu don do. I go tell evribody sey na only Yu dey do good.

17My God, na from wen I bi small pikin, Yu dey tish mi yor ways and I always dey tell pipol about di wonderful tins wey Yu don do.

18Naw wey I don old well-well, make Yu nor leave mi. Make I tell dis new generashon and all doz wey dey porshu mi about yor pawa.

19My God, yor good judgement dey rish di heavens and Yu don do many wonderful tins, so na who bi like Yu?

20Even doh Yu don make mi sofa well-well, I know sey Yu go make mi happy again kon take mi komot from di pit wey I dey.

21I know sey Yu go karry mi put for where dem go for honor mi well, so make Yu turn kon konfort mi.

22Den I go praiz Yu with harp, bikos Yu dey faithful to yor promise. My God, I go use jita take sing praiz Yu wey bi di Holy One for Israel.

23I go shaut for joy kon sing with praiz, bikos Yu don save mi

24and till I die, I go always dey tell pipol about yor good works, bikos evribody wey dey try to kill mi, Yu don disgrace and make shame katch dem.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 71.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.