Psalms 70pcm

1My God, make Yu kwik kom save mi! Hurry kom help mi!

2Make shame and disgrace follow pipol wey won kill mi!

3Pipol wey dey laf dey sey, “Aha! Aha!” Make Yu porshu dem go back kon disgrace dem!

4All di pipol wey dey find Yu, make dem dey happy with joy, bikos of Yu! Pipol wey love to si sey Yu diliver dem, make dem always dey sey, “Make all di praiz bi God own!”

5Dem don opress mi and I nor get anytin! Abeg my God, make Yu kwik kom save mi, bikos na Yu bi my helpa and di Pesin wey dey diliver mi! So make Yu kwik kom!

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 70.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.