Psalms 69pcm

1My God, make Yu save mi, bikos di wota don almost kover mi.

2I dey sink enter mud; di place wey di groun soft well-well. I dey for deep wota and di wota dey karry mi go.

3I don taya to dey shaut for help; sore dey my trot naw and my eye don taya to dey look for my God.

4Pipol wey just hate mi wen e bi sey I nor do dem anytin, many pass di hair wey dey my head. Doz my enemies wey won distroy mi without any rizin, too plenty to kount. Dem dey make mi pay for wetin I nor tif!

5My God Yu know all di sins wey I kommit for sekret; bikos my sins nor fit hide from Yu.

6My God and king wey get pawa; nor let shame katch doz wey trust Yu! Bikos of mi, nor let disgrace follow doz wey dey find Yu.

7I don sofa well-well, bikos of Yu. Na disgrace dem rite full my face

8My own brodas dey trit mi like strenja; dem dey do like sey I kom from anoda kountry.

9True-true, di love wey I get for yor house dey shark mi; so I dey bear di curse wey dem dey curse mi.

10I dey kry and I nor gri chop food and na dis make odas dey curse mi.

11I wear sak klot and dem dey laf mi.

12Doz wey dey sidan for di town gate dey tok about mi and pipol wey don drink, dey sing and laf mi with dia song.

13So my God, make Yu hear my prayers kon favor mi and bikos of yor great love, make Yu ansa and diliver mi!

14Make Yu save mi from di mud! Nor let mi sink! Diliver mi from pipol wey hate mi and from di deep wota!

15Abeg! Make Yu nor let di wota karry mi go! Nor let di wota swallow mi! Make Yu nor let mi die inside di pit!

16My God, make Yu ansa mi, bikos yor love wey nor dey fail, dey good and bikos of how Yu dey sorry for pipol, make Yu turn face mi!

17Nor leave yor savant, bikos I dey trobol, but make Yu ansa mi naw-naw!

18Make Yu kom near and save mi! Make Yu save mi from my enemies!

19Yu know how dem dey curse, disgrace and do mi anyhow and Yu dey si evritin wey my enemies dey do.

20Dia curse dey pain and e dey make my heart kut; I dey look for who go tell mi sorry, but I nor si. I dey find who go konfort mi, but I still nor si anybody.

21Dem dey put poizin for my food kon give mi bad wine make I drink.

22So, make dia food tabol bi trap for dem! Make e bi trap for all doz dia friends!

23Make dia eyes blind and make dem dey shake with fear!

24Make Yu pour yor judgement for dia head and make yor strong vexnashon distroy dem!

25Make dia house turn where pipol go dey trow dirty put and make all dia pipol die finish,

26bikos dem don curse di pesin wey bi yor own. Wen Yu ponish pipol wey bi yor own, na dis wiked pipol dey karry di matter go evriwhere.

27So, make Yu hold dem, bikos of all dia sins! Make Yu nor sorry for dem at-all!

28Make Yu remove dia names from yor book wey get life! Make Yu nor rite dia names join pipol wey dey fear God!

29Dem dey opress and sofa mi! So my God, make Yu diliver and protet mi!

30I go sing and praiz God name! I go dey praiz am as I dey tank am!

31Dat one go sweet God pass ordinary melu or oda animals wey get horn.

32So make pipol wey dem dey opress, happy, bikos God go enkourage doz wey dey obey am.

33God dey listin to doz wey nor get help and E nor go forget en pipol wey dem dey ponish.

34So make di heavens and eart praiz am, plus di sea and evritin wey dey swim inside am!

35Bikos God go diliver Zion kon ribuild Judah town and en pipol go stay der again kon take-ova Zion.

36En savant shidren-shidren go inherit am and pipol wey dey loyal to am go stay der.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 69.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.