1Make God raiz-up! Make all en enemies skata! Make all di pipol wey hate am, run as dem si am.
2As breeze dey blow smoke, na so too Yu go drive dem go and as butter dey melt near fire, na so too wiked pipol go die before God.
3But pipol wey dey fear God go dey happy; dem dey happy for God present and dia joy nor dey end.
4So, make una sing to God! Make una sing praiz en name! Make una praiz di Pesin wey dey ride on-top kloud! Na God bi en name! Make una happy for en present!
5Na en bi papa to di pipol wey nor get papa and na en bi husband to wimen wey dia husband don die. God dey rule from en holy place.
6God dey find place put pipol wey don run komot from dia house bikos of war, E dey free prisonas kon make dem prosper. But pipol wey dey sin, dey stay for desert forever.
7So, my God, wen Yu lead yor pipol go war; wen Yu mash pass di desert,
8di eart dey shake. Yes! Rain dey fall from heaven before di Oga wey bi Sinai God; di Oga wey bi Israel pipol God.
9My God, na Yu make rain dey fall for yor pipol land. Wen yor pipol don taya, na Yu dey give dem pawa,
10bikos Yu dey stay with dem. My God, na yor blessing save doz wey dem dey opress.
11God tok di word; many wimen spread di good news sey:
12“Kings and dia sojas dey run!” So Israel wimen kon divide dia propaty.
13Even pipol wey dey stay for animal house, dey si doves wey get feadas wey dem make with silva and gold wey dey shine.
14Wen God wey get pawa skata kings, dem dey melt like snow for Mount Zalmon!
15Mount Bashan high well-well; Bashan mountin get many top.
16Yu mountin wey get many top, why yu dey jealous di mountin wey God won stay? True-true, God go stay der forever.
17Wen Oga God appear to en pipol for Mount Sinai, E kom with angels and shariot wey nobody fit kount.
18God klimb go where high well-well. E don katch and put many pipol for prison. Even men wey sin well-well dey praiz Yu. True-true, di Oga awa God dey stay for der!
19Na Oga God get all di praiz, bikos na evriday E dey karry awa wahala. Na-im bi di God wey diliver us.
20Awa Oga na God wey dey diliver; di God wey get pawa and wey fit save us from deat.
21True-true, God dey nak en enemies head; E dey nak doz wey dey always do wiked tins.
22God sey, “I go koll dem back from Bashan, I go bring dem kom back from under di sea,
23so dat una go waka on-top dia blood and una dogs go chop una enemies dead body.”
24My God, dem dey si as Yu take dey waka; true-true, my King wey dey mash kom with glory, pipol dey si as E dey kom.
25Pipol wey dey sing, dey waka for en front; while di odas dey play dia instrument dey follow for back and yong girls dey play dia sheke-sheke.
26So, God pipol wey gada togeda, make una praiz di Oga una God!
27Benjamin tribe wey small pass, na dem dey front, den Judah leaders with dia group and di leaders for Zebulun and Naftali tribe, follow for back.
28But God don kommand sey una go get pawa well-well. So, my God wey help us wen wi nor even know, make Yu show yor pawa
29as Yu kom out from yor temple for Jerusalem, bikos kings dey kom give Yu respet for der.
30Make Yu ponish dat wiked animal wey dey wota and di nashons wey dey follow am, until dem go honbol demsef kon offa gold and silva give Yu. Make Yu skata doz pipol wey like war.
31Egypt and Ethiopia pipol go dey ready to kom serve God on dia own; nobody go force dem kom.
32So, make all di kingdom for di world sing praiz God! Make una sing praiz dis God,
33bikos na en bi di Pesin wey dey di sky from one generashon go rish anoda! Si! Na-im dey make dat loud tonda nois.
34Make una tok about di pawa wey God get; en mighty pawa wey dey save Israel and di pawa wey E show from di sky!
35God dey pawaful as E dey kom from en temple. Israel God dey give pawa and strent to en pipol. So make all praiz bi en own!