1Make God show us en favor and bless us! Make E always dey happy with us!
2Den pipol wey dey for di world go know wetin Yu like; all di nashons go know how Yu take diliver yor pipol.
3My God, make evribody for dis world tank Yu! Make all di nashon give Yu praiz!
4Make strenjas happy well-well, bikos Yu dey judge pipol matter well and na Yu dey rule di world.
5My God, make evribody for dis world tank Yu! Make all di nashon give Yu praiz!
6All di seed wey dem plant dey grow well for di eart, so make di Oga awa God, bless us!
7Make E bless us, den evritin for di eart go gi-am di honor wey bi en own.