Bible

Simplify

Your Church Tech & Streamline Your Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 67

:
Nigerian - pcm
1 Make God show us en favor and bless us! Make E always dey happy with us!
2 Den pipol wey dey for di world go know wetin Yu like; all di nashons go know how Yu take diliver yor pipol.
3 My God, make evribody for dis world tank Yu! Make all di nashon give Yu praiz!
4 Make strenjas happy well-well, bikos Yu dey judge pipol matter well and na Yu dey rule di world.
5 My God, make evribody for dis world tank Yu! Make all di nashon give Yu praiz!
6 All di seed wey dem plant dey grow well for di eart, so make di Oga awa God, bless us!
7 Make E bless us, den evritin for di eart go gi-am di honor wey bi en own.