1Make di whole eart shaut with joy as dem dey praiz God!
2Make una sing about di glory wey en name dey bring! Make una tell di world how en glory big rish.
3Make una tell God, “Si as di tins wey Yu do dey great. Yu skata yor enemies with yor strong pawa!
4Evritin for eart go woship Yu; dem go sing yor praiz kon dey shaut for glory as dem dey koll yor name.”
5Make una kom si wetin God don do; di wonderful mirakles wey E do among en pipol!
6E turn di Red Sea to dry land and en pipol kon dey happy as dem dey waka pass di dry groun.
7Na en great pawa E take dey rule forever. E dey si evritin wey di nashons dey do; so make wiked pipol nor dey karry body.
8Make di whole world bless awa God! Make dem shaut tell evribody about en praiz.
9Awa life dey en hand and E nor let us fall.
10My God, Yu don test and make us klean like silva.
11Before-before, Yu katch us for yor net kon make us sofa well-well.
12Yu allow men rule us; wi dey pass thru fire and wota, but naw, Yu don bring us kom where dey save.
13I go enter yor temple with sakrifice; I go do di tins wey I promise Yu;
14di vow wey I tok with my mout and my lip wen I dey trobol.
15I go give Yu fat animals as burnt ofrin, plus di smell from ram wey dem sakrifice. I go give Yu melu and goats.
16Kom! All of una wey dey loyal to God, make una listin as I dey tok wetin E do for mi!
17I kry to am make E help mi kon praiz am with my tongue.
18If I gada sin for my heart, God nor go ansa or listin to mi.
19But God dey hear and listin to my prayers.
20Na God get all di praiz, bikos E nor rijet my prayers and E still dey show mi en love wey nor dey fail!