Psalms 7pcm

1My Oga God, I don kom meet Yu make Yu protet mi. So make Yu save mi from doz wey won kill mi!

2If Yu nor save mi, dem go chop mi like sey dem bi lion and nobody go fit save mi.

3My Oga God, if I don do any wrong tin or dey guilty as dem tok;

4if I sin against my friend or ponish my enemies wen dem nor do anytin against mi,

5den make my enemies porshu and katch mi. Make dem mash mi die kon trowey my body for groun.

6My God, make Yu vex raiz-up for mi, den kon fight my enemies! Abeg, raiz-up make Yu kom fight for mi!

7Pipol for di world gada round Yu, so make Yu rule dem from yor throne.

8Bikos na Yu dey judge evribody, make Yu show sey I dey good, bikos true-true, I dey innocent and na Yu bi di Most High God!

9Make Yu stop di bad tins wey wiked pipol dey do kon defend doz wey dey good, bikos my God wey dey good, know wetin dey pipol mind and heart.

10Na God bi my guide! E dey save doz wey get klean and true heart.

11God dey judge well. E dey vex for wiked pipol evriday.

12If pesin nor gri turn from sin kom meet God, God go sharp en swod kon ready to shot en bow.

13E go ready en swod wey dey kill kon shot en arrow wey dey hot like fire.

14Pesin wey karry wikedness and bad plans for belle, dey born lie-lie.

15E dey dig deep pit for odas, but na en ensef dey fall enter

16and di trobol wey e plan for odas, dey fall for en own head. Na en own wahala dey kause trobol for am.

17So, I go tank God, bikos E dey judge well; I go sing and praiz di Most High God.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 7.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.