Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 8

:
Nigerian - pcm
1 Oga awa God, yor greatness full di whole world! Yor glory high pass di heavens.
2 Yu don tish shidren and small pikin, so dat dem go fit tok about yor pawa and how Yu take silent yor enemies and doz wey dey oppoz Yu.
3 Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do; di moon and di stars wey Yu keep for dia place,
4 I dey ask mysef, “Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem? Na ordinary human being Yu dey kare about?”
5 Yu make dem bi like Yu kon give dem glory and honor.
6 Yu sey make dem kare for evritin wey Yu kreate, bikos Yu put evritin under dia kontrol;
7 all di animals, both wiked and di ones wey nor wiked,
8 di birds for di sky, di fish for sea and evritin wey dey swim for wota.
9 Oga awa God, yor greatness full di whole world.