Psalms 8pcm

1Oga awa God, yor greatness full di whole world! Yor glory high pass di heavens.

2Yu don tish shidren and small pikin, so dat dem go fit tok about yor pawa and how Yu take silent yor enemies and doz wey dey oppoz Yu.

3Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do; di moon and di stars wey Yu keep for dia place,

4I dey ask mysef, “Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem? Na ordinary human being Yu dey kare about?”

5Yu make dem bi like Yu kon give dem glory and honor.

6Yu sey make dem kare for evritin wey Yu kreate, bikos Yu put evritin under dia kontrol;

7all di animals, both wiked and di ones wey nor wiked,

8di birds for di sky, di fish for sea and evritin wey dey swim for wota.

9Oga awa God, yor greatness full di whole world.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 8.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.