Bible

Transform

Your Worship Experience with Great Ease

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 6

:
Nigerian - pcm
1 My God, make Yu nor drive mi, bikos Yu dey vex. Nor ponish mi with yor vexnashon.
2 Make Yu sorry for mi, bikos I dey weak. Make Yu heal mi, bikos my bones dey shake.
3 I dey fear well-well. Na how e go tey rish, before Yu go kon save mi?
4 Make Yu kom back kon help mi. Save mi bikos of yor love wey nor dey fail.
5 Pesin wey don die, nor dey remember Yu. Na who go fit praiz Yu from inside grave?
6 I don taya to komplain, bikos evry nite, I dey wet my bed with wota from my eyes.
7 Sofa don make my eyes blind. My eyes dey weak, bikos of my enemies.
8 All of una wey dey do bad tins, make una leave mi alone, bikos God don hear my kry.
9 God don hear as I dey beg; E go ansa my prayers.
10 So make disgrace follow all my enemies and make dem dey fear well-well! Make dem run turn back, go hide with shame.