Psalms 5pcm

1My Oga God, make Yu listin as I dey pray to Yu! Make Yu listin to my komplain.

2My King and my God, make Yu listin to my kry for help, bikos na only Yu I dey pray to.

3Make Yu listin to my vois for morning, bikos evry morning, I dey kom meet Yu and dey wait with patient make Yu ansa mi.

4My God, Yu nor dey like bad tins; Yu nor fit bear wiked pipol sins.

5So, proud pipol nor go fit stand for yor present, bikos Yu hate anybody wey dey do bad tin.

6Yu go distroy doz wey dey lie well-well. God nor like doz wey dey kill and deceive pipol.

7Bikos of yor love wey nor dey die, I go enter yor house kon bow woship Yu for yor holy temple.

8My God, make Yu save mi as Yu dey lead mi, bikos my enemies dey korna dey wait to katch mi. Make Yu remove all di problem wey dey di road wey Yu dey take mi pass,

9bikos my enemies nor dey tok di trut. Wetin dey hongry dem to do, na to distroy odas; dia troat bi like open grave and na so-so lie-lie words full dia mout.

10My God, make Yu disgrace dem. Make dia own trap katch dem. Make Yu drive dem, bikos of dia sins and bikos dem don turn against Yu.

11But make doz wey Yu dey guide, always dey happy! Make dem always dey shaut for joy! Guide dem, so dat doz wey loyal to Yu, go happy!

12My God, true-true, Yu dey reward doz wey dey fear Yu. Yu dey always protet dem well-well, bikos of yor favor wey nor dey end.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 5.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.