Bible

Elevate

Your Sunday Morning Worship Service

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 4

:
Nigerian - pcm
1 My God, make Yu ansa mi wen I koll Yu. Na only Yu go fit diliver and free mi from wiked pipol and all my trobol. Make Yu sorry for mi kon hear my prayers.
2 Na how long pipol go take dey tok bad about mi? How long una go dey tok wetin I nor do? How long una go kontinue to dey lie for my head?
3 Make una know sey, God dey keep doz wey dey fear am for ensef and E go ansa wen wi koll am.
4 So make yu fear God and nor sin. Make yu tink about am for nite kon turn from yor sins.
5 Make yu offa sakrifice with di rite spirit give God kon trust am.
6 Many pipol dey sey, “Who go fit show us wetin dey good?” So my God, make Yu smile for us.
7 Yu don give mi more joy pass doz wey get many food and wine to drink.
8 I dey sleep with peace, bikos na only Yu wey bi my God, dey save mi.