Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 3

:
Nigerian - pcm
1 My God, make Yu si as my enemies many rish! Many of dem dey kom attack mi.
2 Many of dem dey sey, “God nor go save am.”
3 But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.
4 Wen I kry to God for help, E ansa mi from en holy hill.
5 I dey rest, sleep and wake-up well, bikos God dey protet mi.
6 I nor dey fear, even doh doz wey dey attack mi from evry korna, plenty well-well.
7 My God, make Yu get up! My God, make Yu save mi! Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit!
8 Viktory dey kom from God. So, I dey beg Yu, God sey, make Yu bless yor pipol.