Psalms 3pcm

1My God, make Yu si as my enemies many rish! Many of dem dey kom attack mi.

2Many of dem dey sey, “God nor go save am.”

3But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.

4Wen I kry to God for help, E ansa mi from en holy hill.

5I dey rest, sleep and wake-up well, bikos God dey protet mi.

6I nor dey fear, even doh doz wey dey attack mi from evry korna, plenty well-well.

7My God, make Yu get up! My God, make Yu save mi! Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit!

8Viktory dey kom from God. So, I dey beg Yu, God sey, make Yu bless yor pipol.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 3.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.