Psalms 60pcm

1My God, Yu don rijet and skata awa defence, bikos Yu dey vex for us. But naw, make Yu kom favor us again.

2Yu shake di eart kon tear am into two. So, make Yu join where divide, bikos di eart don dey fall.

3Yu dey trit us with strong hand kon make us drink wine wey dey katch us naw.

4But Yu don give one banner to pipol wey dey fear Yu, so dat dem go dey save wen enemies attack dem.

5Naw, make Yu save yor pipol wey Yu love. Make Yu ansa kon save us with yor pawa.

6God don tok from en holy place sey, “I go defeat di pipol kon divide Shekem land with joy, den I go measure Sukkot Valley.

7Na mi get Gilead and Manasseh! Efraim wey I dey wear like helmet for head, go produce strong sojas and Judah wey I dey wear for body like war klot, go produce kings.

8But Moab wey I dey use as my wosh-hand basin, go bi my savant and I go use Edom take klean my legs kon happy, bikos I don win Filistia pipol.”

9So, who go take mi enter di strong town? Who go fit help mi win Edom pipol?

10My God, Yu don rijet us? Yu nor go follow awa sojas go war again?

11Abeg, make Yu help us fight awa enemies, bikos human being help dey yuzles.

12But with awa God help, wi go get viktory, bikos E go help us mash awa enemies for groun kon win dem.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 60.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.