Bible

Elevate

Your Sunday Morning Worship Service

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 61

:
Nigerian - pcm
1 My God, make Yu hear as I dey kry! Make Yu hear mi as I dey pray for help!
2 From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help, bikos trobol don make my heart heavy. Karry mi go di high mountin, where I go for dey save.
3 True-true, na Yu dey save mi; my strong towa wey dey protet mi from my enemies.
4 Make Yu let mi stay yor temple forever, den I go dey save under Yu.
5 Yu know wetin I promise and Yu don give mi di reward wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu.
6 Mi wey bi king, make Yu give mi long life, so dat I go si my shidren-shidren!
7 Make di king rule with God proteshon forever. Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king.
8 Den, I go dey sing praiz yor name forever kon dey do wetin I promise Yu.