Psalms 61pcm

1My God, make Yu hear as I dey kry! Make Yu hear mi as I dey pray for help!

2From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help, bikos trobol don make my heart heavy. Karry mi go di high mountin, where I go for dey save.

3True-true, na Yu dey save mi; my strong towa wey dey protet mi from my enemies.

4Make Yu let mi stay yor temple forever, den I go dey save under Yu.

5Yu know wetin I promise and Yu don give mi di reward wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu.

6Mi wey bi king, make Yu give mi long life, so dat I go si my shidren-shidren!

7Make di king rule with God proteshon forever. Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king.

8Den, I go dey sing praiz yor name forever kon dey do wetin I promise Yu.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 61.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.