Psalms 59pcm

1My God, make Yu save mi from my enemies. Make Yu protet mi from di pipol wey won kill mi.

2Save mi from pipol wey dey do bad tins and doz wey like wahala well-well.

3My God, si as dem dey wait for korna to katch mi; wiked and strong men dey wait to katch mi, even doh I nor sin or do bad tin.

4I nor do anytin bad, yet dem dey wait to attack mi. Make Yu raiz-up kon si wetin dey happen, den help mi!

5My Oga wey bi kommander for heaven, Israel pipol God, make Yu raiz-up kon ponish doz wiked nashons. Make Yu nor sorry for wiked pipol.

6Dem dey waka round di town for nite like wiked dogs.

7Make Yu listin to how dem dey curse mi and even for publik, dem dey treaten to kill mi dey sey, “Afta wi don finish with yu, nobody go shalenge us!”

8But Oga God, dey laf dem. Yu dey laf all dis wiked nashons.

9Na Yu bi my strent and I dey wait make Yu save mi! Na Yu God, bi my guide!

10My God wey love mi go help mi. E go make mi happy, bikos I win my enemies.

11Make Yu nor kill dem just like dat, bikos my pipol go kwik forget di lesin. So, make Yu use yor pawa take make dem dey waka up-and-down without house, den make Yu honbol dem, bikos na Yu my God, dey protet mi.

12Bikos of di bad-bad tins wey dem dey tok, bikos of di evil wey dey dia lips, make dia own pride, bad mout and lie-lie, trap dem.

13Make Yu distroy dem as Yu dey vex! Make Yu distroy dem finish! Den di whole world go know sey God dey reign for Israel.

14My enemies dey kom out for nite like wiked dog wey dey waka about for street.

15Dem dey find food to chop and even wen dem si chop, di food nor dey rish dem.

16But for mi, I go sing about yor pawa. Evry morning, I go sing with joy about yor love wey nor dey fail, bikos na Yu bi my guide; di place where I dey hide wen trobol kom.

17Na Yu dey give mi strent, so I go sing praiz to Yu. Na Yu dey guide mi; di God wey show mi en love wey nor dey fail.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 59.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.