Psalms 56pcm

1My God, make Yu sorry for mi, bikos pipol dey attack mi. My enemies dey attack mi evriday.

2Pipol wey won si sey I fall, dey always attack mi. True-true many of dem dey fight mi.

3But even as I dey fear, I still trust Yu.

4I praiz God for wetin E don promise. I trust God, so wetin go make mi dey fear?

5Evriday, dem dey kause wahala for mi. All wetin dem sabi, na to dey plan bad tins against mi.

6Dem dey gada hide dey look mi; dey monitor mi as I dey waka and dem dey ready to kill mi.

7So my God, make Yu distroy dem bikos of di bad tins wey dem dey do. Make Yu nor let dem eskape!

8Yu know di pains wey I dey face. As I dey kry, Yu put all my tear for bottol kon rite wetin I dey sofa for yor book.

9My enemies go run wen I koll Yu for help, bikos I know sey God dey for my side!

10I dey praiz God for wetin E don promise. Yes! I go dey praiz am, bikos of en promise.

11I trust God well-well, so wetin go make mi dey fear? Wetin ordinary human being go fit do mi?

12My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu, bikos of how Yu dey help mi.

13Yu don save mi from deat and Yu nor let mi fall at-all, so I go always dey serve Yu, as I dey enjoy dis life.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 56.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.