Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 56

:
Nigerian - pcm
1 My God, make Yu sorry for mi, bikos pipol dey attack mi. My enemies dey attack mi evriday.
2 Pipol wey won si sey I fall, dey always attack mi. True-true many of dem dey fight mi.
3 But even as I dey fear, I still trust Yu.
4 I praiz God for wetin E don promise. I trust God, so wetin go make mi dey fear?
5 Evriday, dem dey kause wahala for mi. All wetin dem sabi, na to dey plan bad tins against mi.
6 Dem dey gada hide dey look mi; dey monitor mi as I dey waka and dem dey ready to kill mi.
7 So my God, make Yu distroy dem bikos of di bad tins wey dem dey do. Make Yu nor let dem eskape!
8 Yu know di pains wey I dey face. As I dey kry, Yu put all my tear for bottol kon rite wetin I dey sofa for yor book.
9 My enemies go run wen I koll Yu for help, bikos I know sey God dey for my side!
10 I dey praiz God for wetin E don promise. Yes! I go dey praiz am, bikos of en promise.
11 I trust God well-well, so wetin go make mi dey fear? Wetin ordinary human being go fit do mi?
12 My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu, bikos of how Yu dey help mi.
13 Yu don save mi from deat and Yu nor let mi fall at-all, so I go always dey serve Yu, as I dey enjoy dis life.