1My God, listin to my prayer. Nor trowey yor face wen I dey kry for help!
2Abeg, make Yu listin kon ansa mi, bikos di trobol wey dey face mi, too mush.
3My enemies dey shaut for mi; dem dey shaut and treaten mi well-well. Dem dey karry wahala kom and dem won kill mi.
4My heart dey beat for my chest and bikos of deat, I kon dey fear.
5I just dey fear dey shake anyhow and I nor fit stop to shake.
6I wish sey I get feada like dove, I for don fly go where I go rest!
7I go fly go far; go rest for wildaness bikos e dey kwayet.
8I go kwik run go where I go dey save from dis pipol wey hate mi well-well.
9So my God, make Yu konfuse and skata dia plans, bikos na wahala and konfushon I dey si for di town.
10Both for day and nite, dem dey waka on-top di town wall and na wikedness and distroshon full der.
11Evritin don skata and na so-so to dey treaten and shit pipol, full di town.
12If to sey na enemy dey laf mi, I for fit bear-am. If to sey na enemies dey make mout for mi, I for fit hide from dem.
13But na yu my klose friend; di pesin wey I like well-well.
14Wi don tell each oda awa sekret; wi dey waka togeda among di pipol wey dey God Temple.
15Make deat distroy my enemies; make di grave swallow dem alive, bikos na wikedness dem dey stay with.
16But I go koll my God and E go kon save mi.
17For morning, aftanoon and nite, I dey kry with pain and God hear my vois.
18E go diliver and save mi from pipol wey dey plan against mi, even doh dem many well-well.
19God wey dey rule forever go hear mi kon deal with dem, bikos my enemies nor gri shange from di wiked tins wey dem dey do and dem nor dey fear God.
20Dem dey attack dia friends and break di promise wey dem make with dem.
21Dia words dey smooth like butter, but dia heart strong like stone. Dia word smooth well-well like pomade, but na dagger dey under dia tongue!
22So make una give all una trobol to God, bikos E kare about una. E nor go allow pipol wey dey obey am, draw fall for groun.
23But Yu, my Oga God! Yu go send wiked pipol go di pit where distroshon dey. Doz wey dey kill pipol and doz wey dey lie, go kwik die, but as for mi, I go trust di Oga, wey bi my God.