Bible

Simplify

Your Church Tech & Streamline Your Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 54

:
Nigerian - pcm
1 My God, make Yu kom with yor great pawa kon save mi! Make Yu defend mi with yor strent.
2 My God, make Yu listin to my prayers. Make Yu listin to mi as I dey beg.
3 Bikos strenjas dey attack mi; wiked pipol dey try to kill mi and dem nor kare about God.
4 But na God dey help mi. Na God dey keep my life!
5 Make evry wiked plan wey my enemies dey plan, turn back go meet dem.
6 I go just give Yu sakrifice on my own! My Oga God, I go praiz yor name, bikos e dey good and
7 Yu save mi from my trobols kon help mi defeat my enemies.