Bible

Designed

For Churches, Made for Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 53

:
Nigerian - pcm
1 Na fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.” Dem don spoil; na bad tins dem dey do and e nor get any one among dem wey dey do good!
2 God dey from heaven look evribody; E dey look to si if anybody really get sense and weda anybody really dey find am.
3 But nor bi so. Evribody don dey sin; evribody don spoil finish. E nor get anybody wey dey do good at-all!
4 Pipol wey dey do wiked tins nor get sense at-all? Dem dey chop my pipol like bread and dem nor ever dey tink sey e good make dem pray to God.
5 Fear go katch dem and na di kind fear wey dem neva si or hear before. God go skata yor enemies bones. God go disgrace dem, bikos E don rijet dem.
6 Na who go kom from Mount Zion kon save Israel pipol? Wen God don save en pipol, den Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.