Bible

Connect

With Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 52

:
Nigerian - pcm
1 Yu wey tink sey yu strong, why yu dey karry body for di bad tins wey yu dey do? Yu nor know sey God love dey always protet mi?
2 Evriday, na how yu go take distroy pipol yu dey plan. Yor tongue dey kut pipol like razor blade and yu sabi lie well-well.
3 Yu like bad tins pass good ones and yu love lie-lie pass trut.
4 Yu wey dey lie well-well, yu like to distroy odas with yor words!
5 But God go distroy yu wons and for all. E go remove yu from yor house kon distroy yu from dis world.
6 Doz wey dey do wetin dey rite, go si am kon happy. Dem go laf dey sey,
7 “Si wetin happen to dis man wey nor trust God and tink sey e strong. E trust en money kon dey happy for di wiked tins wey e dey do.”
8 But I bi like olive tree wey dey grow well inside God house. I go always trust God love wey nor dey fail.
9 My God, I go praiz yu forever, bikos of di tins wey yu don do. I go always dey trust Yu, bikos pipol wey dey obey Yu, know sey Yu dey good.