Psalms 57pcm

1My God, make Yu sorry for mi. Abeg, sorry for mi, bikos na Yu dey protet mi. I go hide under yor shadow until I don free from all dis wahala.

2I kry to di Most High; di God wey dey supply evritin wey I wont

3and E go send help kom from heaven kon save mi, den disgrace doz wey won kill mi. My God go send en goodness and love wey nor dey fail kom.

4Na lions gada round mi so! I dey with pipol wey won kill mi; pipol wey dia tit sharp like spear and arrow and wey dia words dey kut like swods.

5My God, make Yu raiz pass di sky! Make yor glory shine for evriwhere for di eart.

6My enemies don set trap for mi and I don taya bikos of dia wahala. Dem dig deep pit for where I dey waka pass, but na dem go fall enter by demsef.

7My God, I get hope. Yes! I get hope. So I go sing kon praiz yor name.

8So, make my heart wake-up! Trumpet and jita, make una wake-up too! Mi mysef go wake-up for morning with song for my mout.

9I go tank Yu wey bi my God for where evribody dey. I go sing yor praiz among all di nashons.

10Bikos yor love wey nor dey fail, high pass heaven. Yor faithfulnes dey rish di kloud.

11My God, make Yu raiz pass di sky and make yor glory shine kon kover di whole eart.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 57.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.