Psalms 47pcm

1Evribody! Make una kom! Make una klap una hand! Make una shaut praiz God with klean mind!

2Bikos di Most High dey good! Na-im bi di great King for di whole eart.

3E distroy di pipol wey dey before us kon put awa enemies under awa leg.

4E choose and give us di Promise Land as awa propaty for life; di place wey dey make Jakob shidren-shidren happy; di shidren wey God love.

5God dey waka go en throne and pipol dey shaut and blow trumpet as E dey go.

6So, make una sing praiz God; make una praiz am; make una sing praiz to awa King, make una sing praiz am!

7Na God bi di King for all di eart. Make una praiz am with psalms!

8Na God dey rule all di nashons, even as E sidan for en holy throne.

9Di rulers for di world gada togeda with Abraham and God pipol, but bikos na God bi di King of evry king, make una honor am for evriwhere for di world.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 47.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.