Bible

Transform

Your Worship Experience with Great Ease

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 47

:
Nigerian - pcm
1 Evribody! Make una kom! Make una klap una hand! Make una shaut praiz God with klean mind!
2 Bikos di Most High dey good! Na-im bi di great King for di whole eart.
3 E distroy di pipol wey dey before us kon put awa enemies under awa leg.
4 E choose and give us di Promise Land as awa propaty for life; di place wey dey make Jakob shidren-shidren happy; di shidren wey God love.
5 God dey waka go en throne and pipol dey shaut and blow trumpet as E dey go.
6 So, make una sing praiz God; make una praiz am; make una sing praiz to awa King, make una sing praiz am!
7 Na God bi di King for all di eart. Make una praiz am with psalms!
8 Na God dey rule all di nashons, even as E sidan for en holy throne.
9 Di rulers for di world gada togeda with Abraham and God pipol, but bikos na God bi di King of evry king, make una honor am for evriwhere for di world.