1Si as awa God great rish! Wi go praiz am for en own town wey dey on-top en holy mountin!
2Di mountin dey high and fine well-well; di whole eart dey happy to si am! Mount Zion wey bi di holy mountin, na-im bi di town where di great King dey stay!
3God ensef dey for Jerusalem towa and na-im dey defend us.
4Di kings for di eart join togeda kon fight di town.
5But wen dem si am, dia heart kut and fear katch dem, so dem kon run go back.
6Fear katch dem well-well and dem kon dey kry with pain like woman wey won born.
7Yu skata dem like di big sheep for Tarshish wey Yu distroy with di wind from east.
8Wi don hear about di town glory, but naw, wi don si am by awasef; di town wey God wey dey lead heaven sojas, dey and bikos na awa God town, E go protet am forever.
9My God, as wi dey woship for yor temple, wi go always dey tok about yor love wey nor dey fail.
10My God, as yor name bi, na so dem go praiz Yu for evriwhere for di eart. Na viktory full yor strong rite hand.
11Make Zion pipol rijoice. Make all di towns for Judah happy, bikos of di way God dey judge.
12Make una go look Jerusalem; waka round and kount all di towas.
13Make una si as di town walls strong rish and as e dey save, den una go fit tell una shidren-shidren about am.
14Bikos na so God bi! Na-im bi awa God and E go guide us forever and ever.