Psalms 46pcm

1Na God bi di strong place wey wi dey hide put and na-im dey help us wen wi dey trobol.

2Bikos of dis, wi nor dey fear wen di eart dey shake or wen mountins dey fall enter sea.

3River dey make betta nois and mountins dey shake for di strong sea.

4Di wota from di river dey bring joy kom God town; di special and holy place where di Holy One dey stay.

5Bikos God dey stay di town, e nor go skata. Na from wen day just break, God dey protet am.

6Nashons don skata and dia kingdoms dey fall! God shaut like tonda and di eart kon bigin melt!

7God wey dey lead heaven sojas dey with us and na Israel God dey protet us.

8So make una kom si all di wonderful tins wey God don do. Make una si how E dey make di world konfuse.

9E stop all di war for di eart kon break di bow and skata di spear, den E burn di shield with fire.

10God sey, “Make una stand for where una dey, den una go know sey na mi bi God! Evry nashon go honor mi and evribody for di world go praiz my name.”

11God wey dey lead heaven sojas dey with us and na Israel God dey protet us.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 46.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.