Psalms 45pcm

1Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am, just as dem dey use biro rite for book.

2Na yu fine pass among evry oda man! Betta word dey kom out from yor mout and bikos of dis, God ensef don bless yu forever.

3My strong warrior! Make yu karry yor swod kon appear with yor glory and majesty!

4Make yu appear with yor majesty kon ride go defend wetin dey rite, true and good. Dat time, Yu go win yor enemies with yor strong rite hand.

5Yor arrows sharp, e dey shuk yor enemies for dia heart and nashons dey fall for yor leg.

6My God, yor throne go dey forever and ever. Na with royal pawa Yu take dey judge yor kingdom.

7Yu love wetin dey rite kon hate wiked tins. So Oga wey bi yor God don anoint yu as E pour en oil for yor head kon make yu high pass any oda pesin.

8Na myrrh, aloe and kassia dem spray as perfume for yor klot. Dem dekorate yor palis with ivory and na harp dem take dey entertain yu for der.

9Kings dota dey join doz wey kom visit yu and yor kween go wear fine-fine gold and silva wey dem make for Ofir town kon stand near yu for yor rite side!

10All my princess, make una listin to mi kon keep wetin I tok for una heart. Make una forget una pipol and family wey dey far-far.

11Bikos una prince dey happy for una beauti. Make una honor am, bikos na-im bi una oga.

12Rish pipol from Tyre town go kom give una gifts. Doz wey get money go kom make una help dem.

13Di king dota dey always dey happy for en room afta e don wear en fine-fine klot wey dem make with gold.

14Den dem go take am go meet di king as e wear di fine klot with di virgins wey follow am for back

15and dem go happy dey celebrate as dem dey enter di king palis!

16Dia sons go bi king afta dia papa and dem go rule ova many lands.

17I go make evry generashon honor and remember yor name and pipol go praiz yu forever and ever.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 45.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.