Bible

Create

Inspiring Presentations Without Hassle

Try Risen Media.io Today!

Click Here

Psalms 29

:
Nigerian - pcm
1 Make all di angels for heaven honor God; make una honor am, bikos of en glory and strent.
2 Make una honor God, bikos en name get glory. Make una woship God, bikos of en holiness.
3 God vois dey sound on-top di sea and en vois bi like tonda, bikos na en bi di God wey dey kause tonda on-top strong sea.
4 God vois get pawa well-well; en vois get glory.
5 God vois dey break mighty cedar tree! Yes, e dey skata cedar trees for Lebanon.
6 E make Mount Lebanon dey shake like small animal kon make Mount Hermon dey jump like small melu.
7 God vois dey kom with strong lite.
8 God vois dey make di wildaness shake. Yes! En vois dey shake Kadesh Valley.
9 God vois dey bend big trees and skata leaf for forest. Evribody for di temple dey sey, “Make glory bi yor own!”
10 Na God dey rule ova wota and E go bi king forever.
11 Na God dey give en pipol strent and na en dey bless dem with peace.