1Make all di angels for heaven honor God; make una honor am, bikos of en glory and strent.
2Make una honor God, bikos en name get glory. Make una woship God, bikos of en holiness.
3God vois dey sound on-top di sea and en vois bi like tonda, bikos na en bi di God wey dey kause tonda on-top strong sea.
4God vois get pawa well-well; en vois get glory.
5God vois dey break mighty cedar tree! Yes, e dey skata cedar trees for Lebanon.
6E make Mount Lebanon dey shake like small animal kon make Mount Hermon dey jump like small melu.
7God vois dey kom with strong lite.
8God vois dey make di wildaness shake. Yes! En vois dey shake Kadesh Valley.
9God vois dey bend big trees and skata leaf for forest. Evribody for di temple dey sey, “Make glory bi yor own!”
10Na God dey rule ova wota and E go bi king forever.
11Na God dey give en pipol strent and na en dey bless dem with peace.