1My God, I go praiz Yu, bikos Yu save mi and Yu nor let my enemies win mi.
2My Oga God, I dey kry to Yu for help and Yu don make mi well.
3My God, Yu don bring mi kom out from grave. Yu keep mi, so dat I nor go fall inside pit where dead body dey.
4All of una wey dey fear God, make una sing to am!
5Bikos en vexnashon nor dey tey, but en favor dey last forever! Even doh I kry for nite, I know sey joy go kom for morning.
6Dat time wen I don get evritin wey I nid, den I go kon sey, “Nor-tin go fit make mi poor again!”
7But my God, wen yor favor don sikure mi like mountin, Yu kon turn from mi and evritin wey I get kon skata.
8My God, I dey kry and beg Yu for mesi kon sey,
9“Wetin Yu go gain if I die? Wetin Yu go get if I enter grave? Dead body go fit praiz Yu?
10My Oga God, make Yu hear mi kon sorry for mi. Make Yu kom help mi.”
11Naw, Yu don turn my sorrow to happiness. Yu remove di klot wey I take dey mourn kon wear joy for my body like klot,
12so dat I go sing praiz Yu and I nor go kwayet. So, I go tank Yu wey bi my Oga and God forever!