Bible

Connect

With Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 28

:
Nigerian - pcm
1 I dey pray to Yu, my God wey bi my rock. Make Yu ansa mi. Bikos if Yu kwayet, life go taya mi and I go kwik die.
2 Make Yu listin to my prayer for mesi as I dey kry to Yu for help and as I lift up my hand for yor holy temple.
3 Make Yu nor drag mi follow pipol wey dey do wiked; doz wey dey tok like sey dem bi friend to dia neighbour, but dem dey plan bad tins for dem for dia mind.
4 Make Yu ponish dem for dia wikedness! Ponish dem akordin to di bad tins wey dem do, den reward dem for all dia wiked plans!
5 Dem nor kare about di tins wey God do or wetin God make with en own hand. So, God go skata dem finish and dem go disappear forever!
6 I go praiz God, bikos E don hear my kry for help!
7 Na God bi my strent, my guide and I trust am with all my heart. My heart dey happy well-well, bikos God help mi. So, I go always dey sing dey tank am.
8 God dey give en pipol strent and en king dey save, bikos E dey protet am.
9 So God, make Yu save yor pipol! Make Yu bless Israel pipol wey bi yor special propaty. Make Yu guide dem like shepad kon karry dem for yor hand forever.