Bible

Say Goodbye

To Clunky Software & Sunday Tech Stress!

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 150

:
Nigerian - pcm
1 Make wi Praiz God! Make wi praiz am for en temple; make wi praiz am for di sky wey dey tok about en great pawa!
2 Make wi praiz am for di big-big tins wey E dey do; make wi praiz am, bikos en greatness good pass evritin!
3 Make wi praiz am with trumpet sound; make wi praiz am with jita and harp!
4 Make wi dance praiz am with sheke-sheke; make wi praiz am with jita and flute!
5 Make wi dey nak cymbals togeda as wi dey praiz am. Yes! Make wi praiz am with loud cymbals.
6 Make evritin wey dey alive, sing praiz God. Make evribody praiz God!